King Hezekaya and all di ofisas tell Levi pipol sey make dem use David and Profet Asaf psalms take praiz God and dem kon dey happy as dem dey praiz and woship God.
Dem neva do dis kind Passova for Israel since Profet Samuel die. No king for Israel don celebrate Passova like di way King Josaya, di priests, Levi pipol, Israel pipol, Judah pipol and all doz wey dey stay for Jerusalem, celebrate am.
All di pipol wey kom back from Babilon build house kon dey stay der. Dis na di first time wen dem dey do am afta di time wey Nun pikin, Jeshua do am and evribody happy well-well.