But dem nor get enough priest to kill all di animals. So, Levi pipol wey bi dia brodas kon help dem till di work finish and di priest santify demsef. Levi pipol even santify demsef pass di priest.
Dem kill di Passova lamb for di fourteent day for di sekond mont. Di priest and Levi pipol kon dey shame for diasef, so dem go God Temple go klean demsef kon offa burnt ofrin.
Na en work to bring di animal wey dem go burn, di korn ofrin for di New Moon Festival, di Sabat Day and di oda festivals. Na en go provide di ofrin for sins; di korn ofrins, di full animal wey dem go burn as ofrin and di fellowship ofrin, so dat God go forgive Israel pipol dia sins.”