For di temple, Solomon and all Israel pipol kon celebrate Shelta Feast for fourteen days. Many pipol kom from Hamat Road wey far well-well for nort and from Egypt borda for sout.
King Hezekaya and all di ofisas tell Levi pipol sey make dem use David and Profet Asaf psalms take praiz God and dem kon dey happy as dem dey praiz and woship God.
All di pipol wey kom back from Babilon build house kon dey stay der. Dis na di first time wen dem dey do am afta di time wey Nun pikin, Jeshua do am and evribody happy well-well.