Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 30:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 God still help di pipol kom togeda for Judah, bikos dem obey di king and en ofisas kommand.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 30:12
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem gada dia brodas kon santify demsef. Dem kon go inside go klean God Temple, just as di king tok from God word.


Di king follow di advise wey God give King David thru Profet Gad and Profet Natan. E put Levi pipol for di temple with harp and cymbals.


King Hezekaya and all di pipol happy well-well for wetin God do for dem, bikos E kwik-kwik do am.


Dem do evritin wey di king orda koncerning di priest, Levi pipol and di propaty dem.


Ezra kon sey, Make wi praiz di Oga, wey bi awa grand-grand papa dem God! Na-im make di king honor God Temple for Jerusalem like dis.


Wen yu go war, yor pipol go dey happy to follow yu go fight. Na holy garment dem wear for yor body and yor pawa go dey fresh evriday like morning dew.


I go let dem know sey na mi bi God. Den, dem go bi my pipol and I go bi dia God, bikos dem go kom back kon serve mi with all dia heart.


Di only tin wey I go let dem do for dis life: na to always dey honor mi, bikos na for dem and dia shidren-shidren good.


I go give una new heart; di one wey go make una obey my kommand.


But Pita and John ansa, “Make una judge wetin good pass for dis matter; make wi obey una or make wi obey God,


Wi nor dey sey wi go fit do all dis tins by awasef, but na God give us di pawa wey wi take do dem.


Make una nor add join or remove from dis kommand wey I dey give una. Make una just obey di Oga una God kommand wey I dey give una.


bikos na God dey work inside una and una go fit do good tins kon get di pawa wey go make una happy.


Una know di kommand wey wi give una thru Christ.


God wey get peace, di Pesin wey use di everlastin kovenant blood bring awa Oga God Jesus Christ kom back from deat; awa Oga God wey dey look di sheep,


make E give una evritin wey una nid to do wetin E wont. Anytin wey good for en eye, make E do am inside us thru Jesus Christ. Make all glory bi Jesus Christ own forever and ever. Amen!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ