6 E dekorate di temple with precious stones and na from Parvaim dem from bring di gold wey e use.
I don try to prepare silva, gold, bronze, iron, timba, stones wey dear, jem stones to take make di floor and many marbols to take build di temple.
Doz wey get stones wey dear, bring dem kom where dem put di tins wey dem won use take build di temple and na Jahiel wey kom from Gershon family, bi dia leader.
E make di main hall with board wey dem make from evagreen trees; design am with fine gold kon dekorate am with palm trees and shains.
E still design di house, di beams, di wall, di post and all di doors wey dey di temple and e karve tins wey bi like angel for di walls.