17 E put di pila for di temple front; one for di rite side and di oda for di left, den e koll di one for rite, “Jakin” and di left one, “Boaz.”
Simeon sons na: Jemuel, Jamin, Ohad, Jakin, Zohar and Shaul (di pikin wey one Kanaan woman born for am).
Hiram put dis two bronze pila for where dem dey pass enter di temple. Di one wey dey di sout-side na, “Jakin”, while di one for nort na, “Boaz.”
E make strong shains kon put dem on-top di pila. E still make one hundred fruits wey get many seeds kon dekorate and join dem to di shains.
Steps dey wey pesin dey pass go di room for inside wey long rish thirty-five fit and e almost wide rish twenty fit. Two marks dey der: One for each of di side where dem for dey pass enter.