16 E make strong shains kon put dem on-top di pila. E still make one hundred fruits wey get many seeds kon dekorate and join dem to di shains.
Dem kover di temple for inside with gold kon use gold shain cross and kover where dem dey pass enter.
kon put am for one round place wey high pass where dem design with shain. For di main top, na 200 betta stones dey round one pila.
For di temple front, e make two pila and dem long rish fifty-two and half fit and each of dem high rish seven and half fit.
E put di pila for di temple front; one for di rite side and di oda for di left, den e koll di one for rite, “Jakin” and di left one, “Boaz.”
E make di two pila, di two bowl wey dey on-top di two pila, with two shains wey dem design for di top
di 400 fruits wey get many seeds wey dem take design shains for di pilas (each of di design get two of dis fruits on-top di pila),