Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 29:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 kon tell dem, “Una wey bi Levi pipol, make una listin to mi. Make una dey holy, so dat una go fit make una grand-grand papa dem temple holy! Make una remove anytin wey nor dey klean from God Temple!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 29:5
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E tell dem, “Na una bi leaders for Levi tribe. Make una klean all Levi pipol and unasef, so dat una go fit bring di Oga wey bi Israel God, Kovenant Box kom di place wey I make for am.


But dem nor get enough priest to kill all di animals. So, Levi pipol wey bi dia brodas kon help dem till di work finish and di priest santify demsef. Levi pipol even santify demsef pass di priest.


King Hezekaya bring di priest and Levi pipol togeda for di east side for di temple


Make una kill di Passova lamb, dedikate and prepare unasef for una pipol kon do wetin God kommand una thru Moses.”


Di priest and Levi pipol first santify demsef; den dem kon santify di pipol, di gates and di wall.


I kon orda sey make dem do sakrifice take santify di room and make dem put di temple tins, korn ofrins and incense back for der.


My God! Nobody fit shange yor laws! Yor kingdom dey holy and Yu go rule forever and ever.


God tell Moses, “Make yu use today and tumoro take santify di pipol kon tell dem make dem wosh dia klot


E tell dem, “Make una dey ready for di third day and make di men nor sleep with dia wifes.”


I go pour klean and good wota for una body, so dat una go dey klean from di juju wey una dey woship before and evritin wey make una dirty.


Di tin whole my hair with en hand. Den for dis vishon, God Spirit karry mi fly go Jerusalem. E take mi go di gate where dem dey pass for di nort side for di temple and one juju wey dey make God vex, dey der.


God tell mi, “Man pikin, yu si wetin dem dey do so? Si di yeye tins wey Israel pipol dey do for here! Dem dey porshu mi komot from my Holy Place. Yu go even si tins wey bad pass dis ones.”


Make una gada di pipol; prepare dem for di holy meetin; bring di old pipol, den gada all di shidren too. Even pipol wey just marry must kom out from dia bedroom.


Wish kind business God Temple and juju get? Bikos wi bi God Temple, just as God sey, “I go stay inside dem and waka among dem, den, I go bi dia God and dem go bi my pipol.”


So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ