11 My pipol, make una nor waste time, bikos God don choose una to serve and gi-am sakrifice.”
Samuel na Elkanah pikin. Jeroham wey Eliel born, na-im bi Elkanah papa. Eliel na Toah pikin.
I go build betta big temple, bikos awa God big and betta pass evry oda gods.
E enkourage di priests kon sey make dem do dia work well for di temple.
All of una wey bi God savant and doz wey dey serve for God temple for nite, make una praiz God.
For dat time, God separate Levi tribe sey make dem karry God Kovenant Box kon stand for God present to serve am and na dem go dey bless pipol with en name and na so e bi till today.