7 Di remainin tins wey e do wen e dey rule; di war wey e fight and en laws, dem rite dem for Israel and Judah kings history book.
Di remainin tins wey Jotam do, plus all wetin e get, dem rite dem put for Judah kings history book.
Di remainin tins wey Jehoshafat do from biginnin go rish end, dem rite am for Hanani pikin, Profet Jehu book kon put am join Israel kings history book.
Di remainin tin wey King Amazaya do wen e dey rule, dem rite dem for Judah and Israel king history book.
E bi twenty-five years wen e start to rule and e rule for sixteen years from Jerusalem.