Dat diziz sofa King Uzzaya until di day wen e die. Dem separate am from pipol, bikos of di diziz and dem nor let am enter God Temple again. En pikin Jotam kon take-ova as king.
King Uzzaya die and dem beri am near en grand-grand papa for where dem dey beri kings. (Dis na bikos e get skin diziz.) En pikin Jotam kon take-ova as king.
Na for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya bi king for Judah, naim God take show dis message to Isaya, Amos pikin, about Judah and Jerusalem pipol.
Dis na di message wey God give Hosea, Beeri pikin for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah and wen Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel.
Dis na di message wey God give Mikah wey kom for Moreshet town about Samaria and Jerusalem, for di time wen King Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah.