Na Bet-Shemesh, Israel king, Jehoash for katch King Amazaya wey bi Jehoash pikin and Ahazaya grand-pikin. E attack Jerusalem kon break di wall from Efraim go rish di korna gate wey long rish six hundred fit.
For Bet-Shemesh, King Joash katch King Amazaya wey Joash born kon karry am go Jerusalem. Na Jehoahaz born Joash. E skata Jerusalem wall, from Efraim gate go rish di korna gate wey long rish six hundred fit.
Day neva break well wen I leave di town kon pass thru di Valley Gate for west go di sout-side, den I pass Dragon Well go di Dirty Gate. As I dey go, I dey look all di wall wey don break for di town and di gates wey fire distroy.
Hanun and di pipol wey dey stay Zanoah aria, ripair di Valley Gate. Dem ribuild am kon fix di doors, en bolts and bars. Dem still ripair di wall wey bi 1,500 fit wey lead to di Dirty Gate.
All di land from Gibeah aria go rish Rimmon wey dey di sout, go klean like Arabah. But Jerusalem go high pass oda land wey dey round am; di town go start from Benjamin Gate go rish di Korna Gate kon from Hananel Towa go di Royal Wine press.