Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 26:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Dem go meet King Uzzaya kon tell am, “E nor good make yu offa incense give God by yorsef, bikos dat na di work wey priests dey do and na Aaron shidren-shidren dem anoint to dey offa incense. Make yu komot from God house, bikos yu don disobey and nor gri respet am!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 26:18
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Profet Jehu wey bi Hanani pikin go meet di king kon sey, “E dey good make wi help and follow wiked pipol wey hate God? Wetin yu do so, don make God dey vex for yu.


Make una nor bi like una papa wey nor dey obey dia grand-grand papa God wey make am vex distroy dem and una know evritin.


“Yu go separate yor broda Aaron and en sons; Nadab, Abihu, Eleazar and Itama from Israel pipol so dat dem go serve mi as priest.


God tell mi, “Make yu go tell di king and en mama sey, make dem komot for di throne, bikos dia fine crown don fall komot for dia head.


Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.


But na yu and yor sons go do di priest work, evritin wey dey di altar and di Holy Place. And yu must work, bikos I don give yu di gift to bi priest and anybody wey I nor choose, if e kom near di holy tin, dem must kill-am.”


So yu go choose Aaron and en sons kon make dem do di work wey priests dey do; anybody wey try to do dia work for dem, make dem kill-am.”


Bikos of mi, dem go drag una go meet rulers and kings, so dat una go tok about mi give dem and Gentile pipol.


Make una nor fear who go fit kill di body and nor fit kill di soul. Instead, make una fear God wey fit distroy pesin soul and body for hell-fire.


“E marry Herodias wey bi en broda Filip wife.”


How una go fit bilive wen una dey praiz each oda and una nor kare for di praiz wey only God fit give.


So make una give dat pesin to Satan make e ponish am, so dat en sin go komot for en body and Christ go save am for di last day.


So naw, wi nor dey look anybody like ordinary human being. Even doh wi bin know Christ like dat before, wi nor know am like dat again.


But wen Pita kom Antiok, I kon shalenge am, bikos wetin e do, nor good.


Nobody dey fit bi High Priest with en pawa bikos e wont make pipol honor am, but na only doz wey God koll to bi priest, just as E koll Aaron.


My brodas and sistas, since una get faith for awa Oga God Jesus Christ, make una nor dey do parsha.


Dem kon go Gilead land go meet Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon tell dem:


“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ