2 Kronikles 25:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
19 Di win wey yu win Edom pipol don dey won make yu kraze. Make yu stay for yor palis. Why yu won bring wahala kon give yorsef. Why yu won distroy yorsef and Judah tribe?”
King Neko send messenjas go meet am sey, “Judah King! Wetin make yu dey oppoz mi? I nor dey attack yu, na di kingdom wey I follow get war I kom meet and God sey make I hurry. God dey my side, so make yu nor oppoz mi or God go distroy yu.”
God sey, “Make wise pipol nor dey boast, bikos dem wise and make doz wey strong, nor boast sey dem get pawa. Make doz wey get money, nor boast with di money wey dem get.
But E give us plenty grace. Na dis make God word sey, “God dey against pesin wey dey karry body up, but E dey give grace to pipol wey dey put dia body down.”
For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.