David use di town pipol take work well-well with saw, iron hoes and axe, den e force dem make bricks. Na so e do give di pipol wey dey di oda towns for Ammon. Den en and en men kon go back to Jerusalem.
E karry di town pipol kon make dem work with saw, iron hoe and axe. Na so e do with di odas for all di towns for Ammon. Den en and en men, go back to Jerusalem.
Naw, Ammon, Moab and pipol for Mount Seir dey kom! Wen Israel pipol komot from Egypt, Yu nor gri make dem fight dis pipol. Dem just pass and dem nor tosh dem.
Di pipol wey King Amazaya nor gri make dem follow am go fight kon go attack Judah towns wey dey near Samaria and Bet-Horon. Dem kill 3,000 men kon karry many of dia tins go.