11 King Amazaya use strong heart take lead en sojas go Salt Valley, where e for fight and win 10,000 Edom pipol.
David kon popula well-well afta e just kom back from where e for go kill 18,000 Edom pipol for Salt Valley.
E win 10,000 Edom sojas for Salt Valley, katch Sela for war kon gi-am anoda name wey bi “Jokteel” and na dis name dem dey koll am kon rish today.
So, King Amazaya kon tell di sojas wey kom from Efraim sey make dem go house. Dem vex well-well for Judah pipol as dem dey go dia house.
Judah men katch 10,000 men kon take dem go on-top one hill den trow dem go down till dem die finish.
God vex for King Amazaya, so E send one profet go meet and tell am, “Why yu dey follow doz gods wey nor fit save dia own pipol from yor pawa?”
My God, Yu don rijet and skata awa defence, bikos Yu dey vex for us. But naw, make Yu kom favor us again.
Una pride don deceive una, bikos una dey stay under rock where una dey save kon build big house on-top mountin. So una dey boast sey, ‘Na who go fit kon meet and attack us for der?’