So, di king koll Priest Jehoiada kon sey, “Wetin make yu neva tell Levi pipol make dem kollect di tax from Judah and Jerusalem pipol, just as dem rite am for God savant Moses book?”
To take fulfil wetin God promise Israel pipol thru Profet Jeremaya, God kon make King Cyrus for Persia rite law give all of dem for en kingdom for di first year wen e start to rule.
“Wen ever yu dey kount Israel pipol akordin to dia nomba, anybody wey dem kount go pay for en life to di Oga dia God, so dat bad tin nor go happen to dem wen yu dey kount dem.