Di pipol wey kill-am na Jozaka, wey Shimeat born and Jehozabad wey bi Shoma pikin. Dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin, Amazaya kon take-ova as king.
Dem wound am well-well. So wen dem don fight finish, den two of en ofisas kon plan and kill-am for en bed, bikos of Zekaraya wey e kill. Dem beri am for David Town, but nor bi for di royal beri groun.
King Joash sons names, di tins wey dem profesai against Joash and as e take build God Temple again, dem rite am put for di kings book. Amazaya en pikin kon take-ova as king.