2 Kronikles 24:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
24 Even doh Siria sojas small, God let dem win Judah sojas, bikos dem don turn from en wey bi dia grand-grand papa God. Like dis, God kon ponish King Joash.
God Spirit kon enter Zekaraya wey bi Jehoiada pikin. E stand up kon tell di pipol, “Dis na wetin God tok: ‘Why una nor dey obey God kommand? Una nor go prosper and God don rijet una, bikos una nor gri obey am!’ ”
Di Oga wey bi en God kon gi-am to Siria king. Siria pipol win and karry Judah pipol go Damaskus as prisonas. God still gi-am to Israel king and e kon distroy en kingdom.
Only one of una enemies soja go kill 1,000 of una, den wons una si five of una enemies sojas, all of una go run until una nor many again kon small like poles wey dey on-top mountin or sign flag wey dey on-top hill.”
I go ponish una with war, bikos una nor keep di kovenant wey I make with una and if una gada for una towns make una for dey save, I go send diziz wey dem nor dey fit cure among una and una enemies go win una.
My Oga God, di Pesin wey dey holy, Yu wey dey since and go always dey. Oga God wey bi awa Rock, Yu nor dey plan to kill us finish, Yu only send Babilon pipol to kom korrect and ponish us bikos of awa sin.
God go still allow una enemies beat una; una go attack dem from one side, but una go run komot seven side, den all pipol for di eart go dey fear bikos of wetin hapun to una.
una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.