23 As di year dey start, Siria sojas attack Judah and Jerusalem kon karry many tins go Damaskus.
Wen Siria pipol for Damaskus send sojas go help Hadadeza, David attack and kill 22,000 of dem.
Den di profet go meet King Ahab kon sey, “Make yu go back go train yor sojas kon make plan, bikos Siria king go attack una again for di next rainin sizin.”
For di next rainin sizin, e gada en men kon follow dem mash go Afek town go attack Israel pipol.
I go revensh and pay dem back wen dem go fall, bikos di day wen wahala go kom meet dem, don near well-well and dia judgement don almost full!”