Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 24:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 God Spirit kon enter Zekaraya wey bi Jehoiada pikin. E stand up kon tell di pipol, “Dis na wetin God tok: ‘Why una nor dey obey God kommand? Una nor go prosper and God don rijet una, bikos una nor gri obey am!’ ”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 24:20
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den one spirit enter Amasai wey dey lead Di Thirty, so e kon sey, “David, Jesse pikin, wi dey yor side! E go betta for yu! E go betta for doz wey dey help yu! True-true, yor God dey yor side!” So David welkom dem kon make dem ofisas among en sojas.


Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.


Profet Shemaya visit Rehoboam and Judah leaders wey gada for Jerusalem, bikos of Shishak kon tell dem sey, “Dis na wetin God tok: ‘Una don rijet mi, so I go rijet and give una to Shishak.’ ”


Den Zekaraya wey Benaya born, God Spirit kon enter en pikin Jahaziel, for all di pipol present. Na Jeiel wey Matanaya born bi Benaya papa. Dem bi Levi pipol from Asaf family.


Priest Jehoiada and en sons lead di king pikin kom out with di crown and king klot wey dem wear for en body. Dem make am king kon pour oil for en head dey shaut, “Make di king live forever!”


Even doh Siria sojas small, God let dem win Judah sojas, bikos dem don turn from en wey bi dia grand-grand papa God. Like dis, God kon ponish King Joash.


As e dey tok, King Amazaya kon tell am, “Na who choose yu to advise di king? Make yu stop to profesai or dem go kill yu trowey!” Di profet stop kon sey, “I know sey God one distroy yu, bikos of dis tins wey yu do and yu nor gri listin to my advise.”


Bikos of dis, God kon dey vex for Judah and Jerusalem pipol and wetin E do dem dey make evribody shake and fear.


Na di wiked tins wey una do go ponish and kondemn una, bikos una turn from mi. So, una go learn as e betta and wiked rish nor to dey fear mi or forget mi wey bi di Oga una God.” Mi, wey bi God, don tok.


sey, “Go di temple go tell all di pipol from Judah wey dey kom woship for der, evritin wey I kommand yu. Make sure sey yu nor forget anytin wey I tell yu.


Judah, na una kause dis wahala, bikos una dey live yeye life kon dey do bad tins. Na una sin kause dis sofa and e go pain una enter una heart.


So Jeremaya, anytime wey yor pipol ask, “Wetin make di Oga God ponish us like dis? Make yu ansa, ‘Na bikos dem leave God go woship oda gods for dia land and bikos of dat, una must go serve as slave for anoda land.’ ”


But, una sin don make mi stop to dey give una all dis good tins.


Una nor like anybody wey dey judge well or tok trut for kourt.


But Moses ansa dem, “Den why una kon dey disobey God? Una nor go fit win!


So all God pipol blood wey una kill for dis world, go dey una head. From Abel blood go rish Zekaraya wey bi Barakaya pikin, wey una kill for inside di temple.


From wen dem kill Abel go rish di time wen dem kill Zekaraya for di altar inside di temple, dia blood dey dis pipol head and God go judge dem.


For dat time, I go vex for dem well-well kon leave and hide my face from dem until dia enemies kill dem finish. Many wahala and trobol go ovakom dem and dem go sey, ‘Dis wahala don finish us, bikos God no dey with us again.’


Na wons God Spirit enter Gideon body, so e blow trumpet take koll all Abiezer family kom out make dem follow am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ