6 Make nobody enter God Temple escept di priest and Levi pipol wey dey duty. Dem fit enter bikos dia hand klean, but make di oda pipol dey outside.
Anoda part go stand for di palis gate and di oda part go dey di foundashon gate. All di pipol wey remain go stand for di kourtyard for God Temple.
Levi pipol must gada round di king and evribody go hold en weapon for hand. Anybody wey won enter di temple, make una kill-am. Una must follow di king go anywhere wey e dey go.”