5 Anoda part go stand for di palis gate and di oda part go dey di foundashon gate. All di pipol wey remain go stand for di kourtyard for God Temple.
Dis na wetin una go do. Wen dem don divide di priest and Levi pipol wey dey duty for Sabat Day, one part must dey wosh di door.
Make nobody enter God Temple escept di priest and Levi pipol wey dey duty. Dem fit enter bikos dia hand klean, but make di oda pipol dey outside.
God do as Moses wont and all di frog inside dia house, village and farms, kon die.
Some pipol dey always karry one man, wey nor fit waka since en mama born am, kom di temple door-mot wey dem dey koll, “Beautiful Gate”, so dat e go dey beg for money from pipol, wey dey enter inside di temple.