Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 22:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Dem find Ahazaya until dem si am for where e hide for Samaria. Dem bring am kon give Jehu and e kill-am. Dem just beri en body, bikos dem dey respet en grand-papa, King Jehoshafat, wey use all en mind take serve God. E nor get anybody for Ahazaya family wey remain to rule as king.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 22:9
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

and e shaut tell di profet wey kom from Judah, “God sey yu don disobey am, bikos yu nor do wetin E kommand,


All di pipol for Israel go mourn and beri am. Na only en dem go beri well for Jeroboam family, bikos na only en di Oga wey bi Israel pipol God, dey happy with.


Jehu enter di palis kon sidan chop for der. Den e sey, “Make una go trowey dis wiked woman dead body. Make una beri am, bikos na king pikin e bi.”


But yu don still do some good tins before. Yu remove Asherah juju from di town and yu really won follow God.”


Dem attack Judah kon karry evritin wey dem si for di palis; plus di king sons, en wifes, but dem leave en yongest son, Ahazaya.


King Jehoram na thirty-two years wen e bi king and e rule for eight years from Jerusalem. En deat nor pain anybody at-all and dem beri am for David Town, but nor bi for di royal beri groun.


Jehoram kontrol en papa kingdom kon get pawa well-well. Den e kill all en brodas and some ofisas for Israel.


As Jehu dey distroy Ahab family, e kon si Judah pipol ofisas, Ahazaya sons and en relashon wey dey serve am. So Jehu kill all of dem.


Dem wound am well-well. So wen dem don fight finish, den two of en ofisas kon plan and kill-am for en bed, bikos of Zekaraya wey e kill. Dem beri am for David Town, but nor bi for di royal beri groun.


From di time wey King Amazaya stop to follow God, pipol kon dey plan against am for Jerusalem. E run go Lakish, but dem send pipol follow am kon kill-am for der.


Una go pray and woship mi with all una heart and I go dey with una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ