2 Kronikles 22:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
5 E follow dia advise kon go join Ahab son, King Joram for Israel. Dem go fight against King Hazael for Ramot Gilead wey dey Siria and Siria pipol win King Joram and en men.
Ben-Geber dey kare for Ramot town for Ramot Gilead and all di village for Ramot wey Jair town get and na Manasseh grand-grand pikin e bi. E still dey kare for all di aria for Argob for Bashan wey bi sixty big towns wey dem fence round and e get bronze bars.
Den Hazael kon go visit Elisha. E karry gift and forty kamel wey full with all di fine-fine tins wey dey Jerusalem follow body. Wen e rish der, e stand for di profet front kon sey, “Na yor pikin, King Ben-Hadad for Siria send mi kom ask yu sey, ‘I go well from dis sickness at-all?’ ”
Profet Jehu wey bi Hanani pikin go meet di king kon sey, “E dey good make wi help and follow wiked pipol wey hate God? Wetin yu do so, don make God dey vex for yu.
Ahab pikin, King Joram go Jezrel go heal di wound wey e get for Rama wen dem dey fight against King Hazael for Siria and Jehoram pikin, King Ahazaya kon go visit am.
Una dey obey only King Omri wiked laws and una wiked like King Ahab! So, I go use una as ezample kon distroy una finish. Dem go ponish una and evribody wey si una, go laf well-well.”