Jehoshabeat wey bi King Jehoram dota, karry Ahazaya son Joash run komot from di place where dem for won kill di king family. E hide am with one nurse for one room, so dat Atalaya nor go si or kill-am. Na dis Jehoshabeat bi Priest Jehoiada wife.
For di sevent year, Priest Jehoiada kon make plan with five sojas wey bi: Zabud wey Jeroham born, Ishmael wey bi Jehohanan pikin, Zabud wey Obed born, Maaseaya wey bi Adaya pikin and Elishafat wey Zikri born.
My God, Yu dey always trit mi well anytime wey I komplain give Yu. But I ask Yu one kweshon about good judgement: “Why e bi sey wiked pipol dey prosper and pipol wey nor dey honest, dey susid?
My Oga God, di Pesin wey dey holy, Yu wey dey since and go always dey. Oga God wey bi awa Rock, Yu nor dey plan to kill us finish, Yu only send Babilon pipol to kom korrect and ponish us bikos of awa sin.