Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 21:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Dem attack Judah kon karry evritin wey dem si for di palis; plus di king sons, en wifes, but dem leave en yongest son, Ahazaya.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 21:17
8 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jehu meet some pipol wey rilate to King Ahazaya for Judah. Jehu kon ask dem, “Who una bi?” Dem ansa, “Wi bi King Ahazaya family membas. Wi dey go Jezrel go greet Kween Jezebel and di odas for di palis.”


Pipol wey dey stay Jerusalem kon make Jehoram yongest pikin king, bikos Arab pipol wey skata di town kill all di oda shidren. So Ahazaya wey bi Jeroham pikin kon bi king for Judah.


Ahab pikin, King Joram go Jezrel go heal di wound wey e get for Rama wen dem dey fight against King Hazael for Siria and Jehoram pikin, King Ahazaya kon go visit am.


(Atalaya wiked well-well and en sons break enter God Temple kon use all di tins wey dey der take woship Baal juju.)


For Bet-Shemesh, King Joash katch King Amazaya wey Joash born kon karry am go Jerusalem. Na Jehoahaz born Joash. E skata Jerusalem wall, from Efraim gate go rish di korna gate wey long rish six hundred fit.


Una take my gold and silva kon karry all my betta-betta tins go una temple.


God sey, “Gaza pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem sell a whole kountry as slave give Edom pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ