(Dis Judas buy one land with di money wey e kollect for di wiked tin wey e do and na der e hang ensef till en belle burst and all en intestine kon skata kom out,
God go ponish una with boil from Egypt, some part for una body go swell-up, eczema, ring worm and kro-kro go full una body and dem nor go fit cure una.
For morning time, una go sey, ‘If to sey na evening wi dey’ and for evening time, una go sey ‘If to sey na morning wi dey!’ Dis na bikos, di kind tins wey una go dey si around una go make una dey fear.