Solomon get plenty ship wey dey move with Hiram ship. Wen Solomon ship dem kom back evry three years, dem dey bring gold, silva, ivory, apes and fawol kom.
Dodavahu pikin Elieza from Maresha kon tok against King Jehoshafat sey, “Bikos yu enter agriment with King Ahazaya, God go skata wetin yu don make.” Di ship sink and e nor fit go Tarshish again.
Di king get many ship wey go Tarshish with Hiram savants. Wons evry three years, di ship dey kom back with plenty gold, silva, ivory, apes and peacocks.