Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 20:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 So, Jehoshafat kon get peace, bikos God dey protet am for evry side.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 20:30
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den King David kon go stay en house. And God keep am save from en enemies.


Judah pipol happy, bikos dem make dis promise with all dia heart. Dem find God with dia heart and E hear dia kry kon save dem.


Yu nor go fear yor enemies again and pipol go dey kom beg yu for help.


If God sey E nor go do anytin, nobody go fit ask am kweshon. If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin or di hold kountry.


Na from heaven Yu dey judge yor enemies; di eart dey shake and dem dey kwayet for yor present.


Wen pesin make belle sweet God, even en enemies go like bi en friend.


Fear nor go katch yu wen yu dey sleep and yu go sleep well still day break.


I go give una peace for una land and fear nor go katch una wen una dey sleep. I go kill all di wild animals for di land and war nor go dey der.


Israel pipol wey remain, nor go dey sin again. Dem nor go lie and to deceive pipol, nor go dey dia mind again. True-true, dem go dey chop and sleep well and nor-tin go make dem fear again.


Make una mind rest, bikos na my peace I give una. My peace difren from di one wey di world dey give. Make una nor fear or allow anytin worry una mind.


E don tey since God don give Israel pipol rest from dia enemies and Joshua don old well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ