For dat day wen pipol dey happy, dem offa many sakrifice, bikos God don give di pipol rizin to dey happy. Di wimen and shidren still join for di celebrashon and evribody from far know sey betta tin dey happen for Jerusalem.
Una leaders go free demsef and kon free una. From una enemies town, God go take una go back to una own land. Una kings go lead una again and God go guide una by ensef.”
Hannah kon pray dey sey, “My heart dey happy bikos of God; I dey blow my trumpet loud for God. I dey shaut and happy, bikos God don disgrace and save mi from my enemies.