Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 2:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 I dey ready to build one temple to honor di Oga my God and to dedikate am gi-am. I go burn betta incense for am; offa bread and burnt sakrifice evry morning and evening and for Sabat Day too. I go do di same tin for new moon festival and evry oda tin wey di Oga my God tok. Dis na wetin Israel pipol go dey do.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 2:4
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God promise David my papa, ‘Yor pikin wey I go make king afta yu, go build temple for mi.’ And I don choose to build di temple where dem go for woship di Oga wey bi my God.


but God tell am, ‘Yu do well as yu won build temple for mi,


Dem sakrifice 22,000 melu and 120,000 sheep as fellowship ofrin. So di king and all di pipol dedikate di temple.


David kon tink and sey, “Di temple wey Solomon wey bi my pikin go build, must fine well-well, but e still yong naw and e nor know anytin, so I must prepare tins for am.” So David gada many tins keep for Solomon before e die.


Dem dey give God sakrifice wey get betta fine smell both for morning and evening. Dem dey gi-am bread ofrin for klean tabol kon lite di lamp put for di gold lampstand for evening. Wi dey do wetin God sey make wi do, but una don rijet am.


Solomon sey make dem build one temple to take honor God and one royal palis for ensef.


Anytime dem dey woship for di temple, wi go provide dis tins: di holy bread, di korn wey dem dey give evriday as ofrin, di animals wey dem go burn as sakrifice for each day, di holy ofrins for Sabat Day, di new moon festivals and oda festivals, di oda holy ofrins, di ofrin wey go remove Israel sins and anytin wey dem nid for di temple.


My God, no oda god bi like Yu. No one fit do wetin Yu dey do!


God dey great! Make all praiz bi en own! E big pass all di oda gods.


Yu must always keep di Holy Bread wey yu go give mi on-top di tabol.


Evry morning wen Aaron kom prepare di lamp, e go burn sweet incense for di altar.


E karry plenty money follow body and e nor go kom back until mont end.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ