17 Solomon kon still kount all di men wey bi strenjas for Israel, afta en papa David kount evribody for Israel. All of dem na 153,600.
King David kon give orda sey make all di strenjas for Israel gada kom work. E sey make some make block wey dem go use take build di temple.
Solomon get 70,000 ordinary workers and 80,000 men wey dey kut stone for di mountin, plus 3,600 men wey dey supavise di workers.