Mikaya ansa, “I si Israel soja wey skata for evriwhere for di hill like sheep wey nor get who dey kare for dem. And God sey, ‘Dis men nor get leader, make dem go house with peace.’ ”
Leta, one Siria soja shot en arrow kon shuk King Ahab for belle. King Ahab tell di man wey dey ride en horse sey, “Dem don wound mi! Make yu turn komot for here!”
“But if una nor do wetin una promise, I dey warn una, bikos na sin una don kommit against God bi dat. Make una nor konfuse unasef; bikos una go must get di ponishment for una sin.