33 Leta, one Siria soja shot en arrow kon shuk King Ahab for belle. King Ahab tell di man wey dey ride en horse sey, “Dem don wound mi! Make yu turn komot for here!”
Na two hundred men from Jerusalem, Absalom karry follow body. Bikos dem nor know wetin Absalom won do, dem kon follow am with klean mind.
Den Ramot sojas kon know sey e nor bi Israel king, so dem stop to attack am.
As dem dey fight thru-out dat day, di king just sleep for en shariot face Siria pipol. For evening wen sun don go down, di king kon die.
Egypt sojas kon shot King Josaya as dem dey fight, so di king tell en savants, “Make una karry mi komot for here, bikos I don wound well-well.”