King Asa pray to di Oga wey bi en God sey, “My Oga God! Na Yu dey make weak pipol strong. Wi dey go fight dis many sojas, bikos wi bilive sey Yu go help us.”
For di first year wey King Cyrus for Persia dey rule, God make wetin E tok thru Profet Jeremaya happen. E make King Cyrus rite, send and read dis kommand for evriwhere for en kingdom, so dat evribody go hear:
Make Yu listin to di prayers wey mi and yor savants wey dey honor Yu, dey pray. Make Yu help mi today, so dat di king go sorry for mi.” For dat time, na mi dey serve di king wine.