Ben-Geber dey kare for Ramot town for Ramot Gilead and all di village for Ramot wey Jair town get and na Manasseh grand-grand pikin e bi. E still dey kare for all di aria for Argob for Bashan wey bi sixty big towns wey dem fence round and e get bronze bars.
Den e send message go meet King Jehoshafat for Judah sey: “Moab king sey en won fight mi. Yu go follow mi go fight am?” King Jehoshafat ansa, “Okay! I go follow yu, bikos as yu bi, na so I bi too. My pipol na yor pipol and my horse dem na yor own too.”
Afta some years, Jehoshafat travel go meet King Ahab for Samaria. King Ahab kill many sheep and melu as respet for King Jehoshafat with en men wey kom visit am. E beg King Jehoshafat make e join am attack Ramot pipol for Gilead town.
Profet Jehu wey bi Hanani pikin go meet di king kon sey, “E dey good make wi help and follow wiked pipol wey hate God? Wetin yu do so, don make God dey vex for yu.