Mikaya ansa, “I si Israel soja wey skata for evriwhere for di hill like sheep wey nor get who dey kare for dem. And God sey, ‘Dis men nor get leader, make dem go house with peace.’ ”
King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.” King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”