Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 18:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 But Profet Mikaya ansa, “I promise una with God wey dey alive sey, I go tok wetin God sey make I tok!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 18:13
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But Profet Mikaya ansa, “I promise una with God wey dey alive sey, I go only tok wetin God sey make I tok!”


Di ofisas wey go koll Mikaya, tell am, “All di oda profets don profesai viktory give di king. So make yu do di same tin.”


Wen Profet Mikaya rish where King Ahab dey, di king ask am, “Profet Mikaya, Make mi and King Jehoshafat go attack Ramot Gilead or make wi nor go?” Mikaya ansa, “Make una go attack am, bikos God go give una viktory.”


Make di profet wey dream, tok only wetin e dream and make di profet wey hear my message, tok di trut. Nobody fit use tree kanda kompare di main tree.


So, I ansa, “No wahala! I go pray to di Oga awa God just as una tok, den I go tell una anytin wey E tok! I nor go hide anytin from una!”


Yu go tell dem evritin wey I sey make yu tok, weda dem listin or not, bikos I know sey dem sturbon well-well.


But God angel ansa, “Make yu go with di men, but na only wetin I tell yu, na-im yu go tok.” So Balaam kon go with di prince dem wey kom from Balak.


Balaam ansa, “Na only wetin God tell mi, I go fit tok.”


But Balaam ansa, “I nor tell yu sey na wetin God tell mi, na-im I go do?”


‘Even if yu give mi yor house with all yor silva and gold, I nor go fit disobey God kommand to do evil or good just as I wont am, but na anytin wey God tell mi, I go tok.’


Bikos I nor hide anytin from una, as I dey tell una about God plan.


I don already tell una wetin awa Oga God Jesus do for di nite wen dem sell am. And na Christ tok am by ensef. E take some bread for en hand


Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.


Una tink sey, I dey try to do tins make pipol for like mi? Abi I dey do wetin God wont? Or I dey try to make belle sweet pipol? If I dey try to make belle sweet pipol, den I nor bi Christ savant again!


but na God choose us to prish di gospel and na so wi dey prish am. Wi nor dey do am make pipol for praiz us, but make God wey dey si awa heart, praiz us by ensef.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ