12 Di ofisas wey go koll Mikaya, tell am, “All di oda profets don profesai viktory give di king. So make yu do di same tin.”
All di oda profets tok di same tin sey, “Make yu go fight for Ramot Gilead and yu go win dem, bikos God go give yu viktory.”
But Profet Mikaya ansa, “I promise una with God wey dey alive sey, I go tok wetin God sey make I tok!”
But yu still ask, ‘Wetin God know? How E won take judge us thru dis tick darkness?’
Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us! E don klose en eye and E nor go even fit si wetin wi dey do!”
Dem tell di pesin wey dey si vishon sey, “Make yu nor si any vishon for us” and dem tell di profet sey, “Make yu nor tell us di rite tin again!” Dey tell us betta and sweet tins. Make yu just dey lie give us.
Di pipol dey deceive di king and en ofisas with all dia evil plans and di prince dem dey make di king happy with dia lie-lie words.
Nor profesai for Bethel again, bikos na here di king for dey woship for di main temple.”
If lie-lie profet kon tell una sey, “Make una dey drink wine and plenty strong drink!” Una go happy, bikos dat na di kind profet wey una dey like!
But di pipol tell mi, “Make yu nor tok like dat. Nor prish like dat, bikos dat kind wahala nor go ever happen to us!”
dem kon join togeda won go fight against Joshua and Israel pipol.