5 Bikos God guide en kingdom, Israel pipol kon take gift go give Jehoshafat, so e get enough money and pipol kon dey respet am.
(Naw, Abram get many animals, silva and gold.)
Evribody wey dey kom, dey bring gold, silva, robes, weapons, spices, horse and mule. And dem dey bring dem kom evry year.
Wen Solomon dey rule, silva dey evriwhere like ordinary stone for Jerusalem and cedar tree dey kommon like ordinary trees for Jerusalem.
Na Solomon dey kontrol all di nashons from Eufrates River go rish Filistia and Egypt borda. Dem dey under am dey pay tax gi-am till e die.
Di king make silva and gold plenty for Jerusalem like san-san; cedar wood many for Jerusalem like sikamore fig tree wey dey di low lands.
Afta King Jehoshafat get money kon popula well-well, e sey make one pesin for en family marry from King Ahab family for Israel.
Many pipol bring tins kon give God for Jerusalem and dem still give betta gifts to King Hezekaya for Judah. From dat time go, all di nashons kon dey respet am.
Di king make silva plenty for Jerusalem like san-san. Cedar wood plenty, just as sikamore fig tree plenty for di low lands.
God bless di remainin days wey Job stay for dis eart pass wen dem born am. Job kom get 14,000 sheep, 6,000 kamel, 2,000 kattle and 1,000 donkey.
Unless God build house, di pipol wey dey build am, just dey waste dia time. Unless God guide town, doz wey dey guide am, nor go fit protet am.
Den if yor shidren-shidren obey di kovenant and di laws wey I tish dem, dem go bi king forever.”
as Yu kom out from yor temple for Jerusalem, bikos kings dey kom give Yu respet for der.
Tarshish kings for west and di oda kings go kon pay respet to am. Sheba kings for east and Seba go kon gi-am gifts.
So, wen una vow give di Oga una God, make una keep una promise. Make evribody bring gift kon give di Holy One!
Make kings nor like wiked tins, bikos na korrect judgement dey make govment strong.
Dem enter di house, si di pikin with en mama kon knee down woship am. Den dem open dia bag kon gi-am some gifts wey bi, gold, frankincense and myrrh.
But make una first do di good tins wey God wont and evry oda tin go bi una own.
Afta una don sofa small, God wey koll una with en grace enter en glory for Christ, go make una komplete, una leg go strong and una go get pawa.
But some wiked pipol sey, “How dis man go fit take save us?” Dem curse am and dem nor gri kom gi-am gift. But Saul nor tok anytin.