16 and Amasaya wey bi Zikri pikin wey sey e go serve God, dey lead 200,000 strong sojas wey get skill.
“But who mi and my pipol bi? Wi nor really fit give Yu anytin, bikos na Yu get evritin and wi dey give Yu wetin Yu first give us.
I know sey Yu dey test evribody heart and Yu dey like doz wey dey respet diasef. I put my body for groun kon use all my heart take give Yu all dis tins and I don si how all yor pipol dey happy as dem dey give Yu dia gifts.
Di pipol use dia mind take give and dem happy sey dem don give many tins to God. So David kon dey happy too.
Jehohanan wey bi kommander, dey lead 280,000
From Benjamin family: Eliada wey bi strong soja dey lead 200,000 men wey karry bow and shield,
Wen yu go war, yor pipol go dey happy to follow yu go fight. Na holy garment dem wear for yor body and yor pawa go dey fresh evriday like morning dew.
Bikos if e really dey una mind to do am, anytin wey una give akordin to wetin una get, God go asept am, but nor bi wetin una nor get.
“Make una praiz God! Israel leaders agri to go fight and di pipol happy follow dem.
I like doz leaders for Israel and doz wey gri to fight war. Make wi praiz God!