E still build towas wey e fence; dig many well for di desert, bikos e get many animals for di hills and plain land. E get pipol wey dey work for am for en farm, vineyard, di hills and for Mount Karmel, bikos e like farm work well-well.
King Hezekaya use all en pawa take build di wall wey dem break. E build towa and wall for outside kon fence David Town round. E make many weapons and shields.