Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 16:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 For dat time, Profet Hanani visit King Asa for Judah kon tell am: “Bikos yu bilive Siria king pass God, yu nor go fit win Siria sojas again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 16:7
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di message wey e send go na: “Make wi bi friends, just as awa papa dem bi. Dis silva and gold na di gift wey I give yu. Make yu nor bi friend with King Baasha for Israel again, so dat e go remove en sojas from my aria.”


God send Profet Jehu, Hanani pikin, go meet and give Baasha dis message:


Na God give Profet Jehu di message wey e tok against King Baasha and en family, bikos of di sin wey dem kommit. Nor bi only en wikedness dey make God vex, but na bikos e kill evribody for Jeroboam family.


E trust di Oga wey bi Israel God; so e nor get any king like am wey don rule Judah before or wey go rule Judah again.


Dem ask and pray to God make E help dem and God ansa dia prayers kon make dem win di war.


So Judah men win Israel pipol, bikos dem trust and bilive dia grand-grand papa God.


King Asa pray to di Oga wey bi en God sey, “My Oga God! Na Yu dey make weak pipol strong. Wi dey go fight dis many sojas, bikos wi bilive sey Yu go help us.”


King Asa orda Judah men sey make dem karry di stones and wood wey Baasha take block Rama komot. E kon use dem take build Gibeah and Mizpa.


Profet Jehu wey bi Hanani pikin go meet di king kon sey, “E dey good make wi help and follow wiked pipol wey hate God? Wetin yu do so, don make God dey vex for yu.


E follow wetin Asa en papa do and e dey kareful and dey do only wetin God wont.


Di remainin tins wey Jehoshafat do from biginnin go rish end, dem rite am for Hanani pikin, Profet Jehu book kon put am join Israel kings history book.


Even doh Siria sojas small, God let dem win Judah sojas, bikos dem don turn from en wey bi dia grand-grand papa God. Like dis, God kon ponish King Joash.


Pipol wey dey go Egypt for help, curse dey dia head! Dem dey put dia hope for di plenty sojas, ordinary horse and shariot wey Egypt get. But dem nor trust Israel God or kom meet am make E help dem!


Dem go bi like house wey pesin hide put bikos of heavy rain. Dem go bi like wota wey dey rush for desert; like big rock wey en shadow kover empty land.


Den Profet Isaya go meet King Hezekaya kon ask, “Where dis men from kom and wetin dem wont?” King Hezekaya ansa, “Dem kom from Babilon wey far well-well.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ