5 Wen King Baasha hear di news, e karry en sojas kon komot from Rama.
All di time wey King Asa for Judah and King Baasha for Israel dey rule, na so-so fight dem dey fight demsef.
Wen King Baasha hear wetin happen, e pak en sojas from Rama kon go Tirzah.
King Ben-Hadad gri with wetin King Asa tok, so e send en sojas go attack Israel towns. Dem win Ijon, Dan, Abel-Maim and all di towns where Naftali pipol dey keep tins put.
King Asa orda Judah men sey make dem karry di stones and wood wey Baasha take block Rama komot. E kon use dem take build Gibeah and Mizpa.