Di remainin tins wey Jehoshafat do from biginnin go rish end, dem rite am for Hanani pikin, Profet Jehu book kon put am join Israel kings history book.
Di remainin good tins wey Hezekaya do, dem rite dem for di book wey bi Profet Isaya wey Amos born, own. Dem still rite dem for Judah and Israel kings history book.
Di remainin tins wey Solomon do, from biginnin go rish di end, dem rite dem put for di book wey Profet Natan rite; plus Ahijah for Shiloh profesy; Iddo wey dey si vishon and di vishon about Jeroboam wey bi Nebat pikin.