Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 15:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 E gada all Judah and Benjamin pipol, plus di pipol wey dey for Efraim, Manasseh and Simeon tribe wey dey with am. Many pipol from Israel kom stay der wen dem si sey di Oga God dey with am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 15:9
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem ansa, “E klear sey God dey with yu. So wi kon sey, make peace dey between us: dat is between wi and yu. Make yu allow us make peace with yu,


En oga kon si sey God dey with am and God dey make evritin wey Josef do, betta.


And na since den Israel pipol for nort, bigin fight against David kingdom.


Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.


Some from Manasseh tribe still go meet David wen e follow Filistia pipol go fight Saul. (But, e nor help di Filistia pipol, bikos dia king dey fear sey e go sell dem give Saul wey bi en oga before, so dem send David and en men go back to Ziklag.)


All di pipol for Israel wey won woship Israel God follow dem go Jerusalem go sakrifice give dia grand-grand papa God.


For fifteen years wen Asa don bi king, dem kon gada for Jerusalem for di third mont.


As Jehoshafat dey stay for Jerusalem, e dey follow di pipol travel from Beersheba go di hill kountry for Efraim and e dey advise dem make dem follow dia grand-grand papa God.


All di pipol wey gada for der na: Judah pipol, di priests, Levi pipol and strenjas wey dey stay Israel and Judah land.


“Man pikin, take one stik make yu rite dis word put, ‘Judah kingdom.’ Den take anoda stik kon rite dis word put too, ‘Israel kingdom.’


Dat time, di church wey dey Judea, Galilee and Samaria get rest and dis kon make dem strong as dem dey stay togeda, dey woship God with all dia heart and as di Holy Spirit dey tok to dem. So pipol wey dey di church kon dey plenty more-more.


Wen Saul know sey God dey with David and en pikin Mikal love David well-well,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ