E allow Babilon king kill all dia yong men for dia temple. E nor sorry for di yong men or wimen, or even di old pipol. God give all of dem to Babilon king.
God sey, “I go make war happen for Egypt, dat time, broda go fight against broda and neighbour go fight against neighbour. Town go fight against town and kingdom go fight against kingdom.
kon ova-trow and take kingdoms pawa from dem. I go distroy shariot and di pipol wey dey drive dem; di horse go die and di pipol wey dey drive dem, go kill each oda.
Difren kountries and kingdoms go fight each oda. Eartkweke and honga go dey for many place. But wen di wahala won start, e go bi like wen woman won born.