E go meet King Asa kon tell am, “King Asa, Judah and Benjamin tribe, make una listin to mi! As long as una dey obey God, E go always dey with una. If una koll am, E go ansa una, but if una rijet am, E go rijet una too.
God sey, “Una wey wont make dem save una; una wey dey kom meet mi make I help una. Make una tink of di Rock wey una from kom, di place where dem from kut una from.
Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.
so make yu tell di pipol sey, “Dis na wetin God wey dey lead heaven sojas tok: ‘Make una turn kom meet mi and I go kom meet una too, dis na wetin Oga God wey dey rule ova evritin, tok.’
And Profet Isaya even get strong heart to tell di pipol sey, “Pipol wey nor look for mi, na dem si mi. Doz wey nor ask for mi, na dem kon know mi well-well.”