Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 15:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 For sometaim naw, Israel pipol nor get di true God or priest wey go tell dem di law or wetin to do.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 15:3
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For di third year wen e dey rule, e send Ben-Hail, Obadaya, Zekaraya, Netanel and Mikaya wey bi en ofisas go tish pipol for Judah towns.


Wen di pipol hear wetin dem read for di law, di word tosh dem sotey dem kon start to kry. So Nehemaya wey bi di govnor, Ezra wey bi priest wey know di law well-well and Levi pipol wey dey esplain di law kon tell all di pipol, “Today dey holy for di Oga wey bi una God, so una nor suppose mourn or kry.


But na only Yu Oga, bi di true God. Di God wey dey alive and Yu go rule forever. Anytime Yu dey vex, di world dey shake and nobody fit stand wen Yu dey vex.


Di town gates don sink enter groun. E skata all di keys and bars wey dem take dey lock di gates. Dem take en prince dem and kings go Babilon as slave. Law nor dey again and God profets nor dey get any vishon from am again.


Dis tin show sey na so too Israel pipol go dey: dem nor go get king or leader; dem nor go do sakrifice or serve stone again and dem nor go get juju or image wey dem go use take konsult dia gods.


Yu must tish di pipol all di laws wey I don give yu thru Moses.”


Di time dey kom wen I go send honga kom di land. Pipol go dey hongry, but nor bi for food. Dem go dey thirsty, but nor bi bikos of wota; instead dem go dey hongry to hear God message.” Oga God don tok.


Una leaders nor dey judge well, bikos dem don take bribe and una priest dem dey do dia work, bikos of money. Una profets nor dey profesai unless dem first pay dem. Yet all of una sey una trust God. Una sey, “Nor-tin go happen to us, bikos God dey with us.”


Na priest work to tish di trut about God. So make pipol go meet and learn wetin I wont from dem, bikos na Oga God send dem.


Life wey nor dey end, dis na wetin e mean, ‘Na make pipol know yu wey bi di only true God and Jesus Christ, wey yu send.’


Even doh Gentile pipol nor get Moses Law, God still dey ponish dem wen dem sin, so Jew pipol wey get di law, wen dem sin, na di law go judge dem.


And wen I dey with pipol wey nor dey live by di law, I nor dey use di law for dem, so dat I go fit win dem. But dat nor mean sey, I go forget God law, bikos na Christ law dey rule mi.


Dem go tish Jakob yor law kon tish Israel pipol yor kommand: dem go offa betta incense for Yu kon burn good ofrin for yor altar.


Pipol dey tok about how una welkom us and leave di juju wey una dey serve before kon follow di true God wey get life.


Leader for church must bi pesin wey nor get fault; wey get only one wife; fit kontrol ensef; get sense and respet; dey welkom pipol and e bi good tisha.


Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ